Tuesday, 27 November 2012

1year and 7months Old Pikin Wey Dem Abandon In Oleh, Delta State


Na wa o one person for my area for Oleh, A town located in the Southern Part of delta state (Isoko) Nigeria, Just sent me this pikin picture say one person drop the pikin outside his office this morning.
I non know wen some people go get sense o! Pikin wen u carry for 9months u go just drop am put for one place say one thin happen or the other.


According to this person wey sent me d picture so him talk say, the pikin when dey the picture so, na 1year and 7months old pikin, the pikin neva fit talk neither waka..

My people wetin una see about this tin so? because him talk dem neva still see the mother or the father of this pikin.

No comments:

Post a Comment

Say Something about this Post