Tuesday 18 December 2012

9ja News: Pipeline Fire Don Kill Many People in Lagos


 Omg Christmas don dey reach o! wetin dey happen na? na yesterday people die finish for bus wey dey carry people for delta state.
Today na one vandalised pilpeline site wen dey for Lagos. Them say some group of gang go steal Oil, wey the number of gallon wen dey steal was yet to be ascertained as for yesterday wey be Tuesday.

Read more of the tori after the cut
Dem Also talk say fire don burn people to death wen dey dem scoop fuel for the pipeline yard wey dey Ije-Ododo, Near Ijeun in Iba Local Council Developement Area Of Lagos State for there.

People wey use their koro koro eye see am wey be (Eyewitness) say the fire started around 9pm wen about 30 people come the place of the incident to scoop fuel into hundreds of 50kg jerry Cans from the burst pipeline.
Dem also talk say immediately after 1min,  fire burst out, burning people wen dey scoop the fuel and their material. The Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) and Nigeria National Petroleun Corporation (NNPC) oga's dem also they around to assess the matter.

The stori still continue small if only you proceed to Thisday

No comments:

Post a Comment

Say Something about this Post