Wednesday 29 August 2012

Photo: Must Laugh


Seriously i don't what to laugh today but i can't just pass a minutes without laugh you know what that means?.

14 comments:

  1. heheheh Omg OGUSWetin be dis na?

    ReplyDelete
  2. Hahahahahaha see ds chinco ooo. Lol

    ReplyDelete
    Replies
    1. hmm shey u stil dey around? i tink say u doon carry my k******s Gooo

      Delete
    2. Haa noo am not going anywhere oo.

      Delete
  3. hmmm, mumu Naija police.

    ReplyDelete
    Replies
    1. no be their fault na wetin u expect

      Delete
  4. E be like say the person wey get this slippers take oath with the slippers say dem no go ever seprate till death do them part. Ogus, this slippers na your size. You sure say no be your own?

    ReplyDelete
  5. hehehe Na Basket Mouth Own oh abeg make una non go tell am say i revealed his pri 6 secret give una oh i be won use am do post but hmmm i pity am, if can remember look deeply inside the slippers lolz talk truth shey e non resemble Basket Mouth? No Fear ooo afterall na wetin? Joke :P

    ReplyDelete
  6. Ogus, no be for my mouth you go hear say rev. Father commit fornication. I go give you my answer for your inbox. I no wan make person trace me because of wetin i yarn come renovate this my fine face.

    ReplyDelete
  7. *Fine face* shey i hear wetin u talk so? E be like say breeze blow am comot oh, abeg park jor, who be dat gal wen dey deceive u so, she must pay for dis, why she go look u finish nd she tell u say, darly u ar handsome? Abeg na fact i dey tell u so after u might hav read dis look mirror tell ur say u non fine as my broda Sheyi Law confess giv me say na him wowo pass, abeg tell us jor e non go remve anytin from ur body.....

    ReplyDelete
  8. @ OGUS: No dey form "lagbaja" for here. Show your face make babes wey dey read this blog judge between my face and your own which one wey wowo pass. *By the way, na my cousin pic be this. Google and facebook reject my picture. No ask me why. U yourself know the reason but no talk am for here.*

    ReplyDelete

Say Something about this Post